Trump promise evri adult American $5,000 if Republicans win di midterm elections
US President Donald Trump say im go give evri adult American $5,000 (£3,700) payout if Republicans win both chambers of Congress for November midterm elections – one plan wey go cost more dan one trillion dollars.
Oga Trump make di offer for one speech for di party first-ever convention for di middle of one US presidential term.
E no give details on how e go take work or wia di money go come from – e only say dem must spend di money for US.
Vice-President JD Vance don link di plan to di revenue wey Trump raise from di US govment tariffs.
Di plan prove say e dey controversial. Democrats don label am as "empty promise" and odas don question weda dat kain promise dey legal.
Dis fit be di first time a US president go offer dat kain payout to Americans, for di context of one election year plea to get out and vote.
Di idea bin draw plenty applause for di convention and e be like say Trump enjoy di moment.
Na nearly 270 million American adults dey, wey mean $5,000 payout go cost di US govment some $1.3 trillion.
Source: bbc

Article comments